Thursday, March 27, 2025

Day Three: We Need Help, We Don Tire To Dey Bathe For Road

 


What’s up people, it’s day three of my thirty days rant challenge and am feeling hopeful for I heard a good news that has nothing to do with me. The government has finally started paying NYSC corp members the new minimum wage allowance. No more thirty three thousand naira, and am truly happy for Nigerians and those that made this possible. Also, the government for listening to our rant, putting it into consideration and hoping that more good news will come. 

Ok, let’s begin. Straight to the point as always. A lot has happened, not just for the past few years, it’s still happening in my very before. I don’t like stress but the country is draining the life out of me. I think I will have to take this personal cause raining season never start well yet dem don already Dey splash person water. Then imagine when it starts raining back to back, wetin man go do. That means we go Dey bathe for road each time we wan comot go somewhere. 

https://punchng.com/2025-rains-little-hope-for-federal-roads/?amp

To be sincere, I don tire oo. I no need that kind embrassment anytime soon, it’s annoying. Even the one wey dem they bathe car with dirty water Dey vex person, how much more if na human being dem bathe that kind water. The vex go reach boil hot water naa or rather cook beans sef if na hot tempered person. But that’s not the only problem we get when it comes to bad road. We’ve recounted several issues over the years in terms of accident, heavy traffic and so many others yet little or no impact has been made. 

https://businessday.ng/business-economy/article/poor-roads-sink-hope-for-nigerias-economic-growth/?amp

Like WTF will they build roads that will spoil in the next one to two years if they wan try sef. Some na repair dem repair am every year, Dey waste money. After the road don bathe us finish for that season dem go rush patch am up for December if Dey wan do good make e be like say dem Dey work if not, e go remain till the next elections for the state. And am wondering what happens to building roads that can last at least ten to twelve years minimum or more since it’s for the general public.

Roads wey me and you go Dey use we Dey do like this. Ohh, I forgot, government officials no to Dey use roads na by air dem Dey go right? But even at that, na beg we wan beg again. We don tire to Dey bathe for road, we get bathrooms for house. Please we no need extra bathrooms for road, Government should come to our aid now before raining season go start wella wella.

https://www.vanguardngr.com/2025/03/fly-nigeria-act-what-analysts-say/amp/

As you never get car, surely dem go bathe you unless you no wan comot for house so may we all put mouth for this matter and hope for a positive result. Cause I no get money to buy extra perfume and deodorant wey I go Dey carry for bag incase dem bathe me for road. 

I rest my case

Bye for now